Thursday, September 17, 2009

TALK IS CHEAP 5

Everybody wetin dey?how una dey?me i dey bam bam,still dey rep the green white green.(are u suprised)

iam about to start blogging in pidgin.iam on some no more no vernacular,teacher no teach me nonsense level(bantu style).make we yarn small.......

MUSIC YARN
E get dis guy wey i dey feel big time now,na ACE be hin name.if you never hear hin tracks,download am for here.that hin "finger work" song dey tite(shey blogging na finger work?i no know sef!help me ask ace when una see am).

Omo,da grin get mouth(ole nu pa).hin album CEO(chief executive omoita) hot like fire.try buy am.

I think i tell una,dat boy oluwe na something else.hin new song "ewe lowo" where hin feature dagrin na straight banger.dat song too tight(awon boys won koje bi ewe).

Yes boss,i hear say naeto c and ikechukwu no dey yarn again.(wetin cerious music don join together,make no mo hits put am assunder).

Abeg,make una helep me yarn kel say i don dey move,dat her album "the investment" dey blow my mind.

Dat don jazzy boy waka don dey fear me,i hear say hin wan sign terry g.(abi him wan pai everybody for industry)

VIDEO YARN
Walahi,i no dey watch videos again.who even release video sef?nothing dey happen for here jo.

DJ zeez,where you dey?wey the video for fokasibe?i don tire to dey wait?

Ehen!!!i hear say dem nominate some of my boyz for video awards.i no even remember which kain award dem call am sef.....em....em....em........OKAY!!!!!na mtv africa music awards.Tuface get 4,Dbanj get 3,M.I & P square get 2,Kel,Dare art alade & Bigiano get 1.na the full list be this.

Best Male
2 Face (Nigeria)
HHP (South Africa)
D’Banj (Nigeria)
Nameless (Kenya)
Da L.E.S. (South Africa

Best New Act
M.I. (Nigeria)
Shaa (Tanzania)
STL (Kenya)
Bigiano (Nigeria)
Rhythmic Elements (South Africa)

Best Hip Hop
M.I. (Nigeria)
A.Y. (Tanzania)
Zulu Boy (South Africa)
Jay-Z (USA)
Kanye West (USA)

Best Female
Kel (Nigeria)
Amani (Kenya)
Lira (South Africa)
Zamajobe (South Africa)
Lizha James (Mozambique)

Best Performer
P-Square (Nigeria)
D’Banj (Nigeria)
Samini (Ghana)
Nameless (Kenya)
Blu*3 (Uganda)

Best R&B
2 Face (Nigeria)
Darey Art Alade (Nigeria)
Loyiso (South Africa)
Beyoncé (USA)
Akon (USA)

Best Group
P-Square (Nigeria)
Blu*3 (Uganda)
Gang of Instrumentals (South Africa)
Mo Hits Allstars (Nigeria)
Gal Level (Namibia)

Artist of The Year
2 Face (Nigeria)
D’banj (Nigeria)
Lira (South Africa)
HHP (South Africa)
Nameless (Kenya)

Best Alternative
Green Day (USA)
Coldplay (UK)
Cassette (South Africa)
Zebra & Giraffe (South Africa)
Aking (South Africa)

Best Video
2Face – Enter The Place (Nigeria)
XOD – I Want You Back (Uganda)
HHP – Mpitse (South Africa)
Da L.E.S. – We on Fire (South Africa)
Wahu ft Bobi Wine – Little Things You Do (Kenya).

e be like say na only 2face & dbanj e sure for.na wetin me i think be dat o...make una go vote for www.mama. mtvbase.com or www.mtvmama.mobi. before october 5.

E DEY HAPPEN
If u never hear,if na abeokuta u dey stay(under rock).make i give you latest gist.sean paul dey come naija september 25th,na dem odeme people(guinness) dey bring am come.no dull yourself o.wetin just dey pain me be say dem no invite pype make hin come perform for there.maybe if hin perform,sean paul fit like am,carry am go yankee.MI,Dbanj,Tuface,P square & Wande coal go dey there.

Ramadan kareem to my muslim people dem dem.abeg no forget to send my ram o.wetin i know be say one place go dey online where you fit buy e-ram,so i go check my email when time reach.

3 comments:

  1. Guess the rest of us non-Nigerians will just have to learn pidgin lol.

    ReplyDelete
  2. bros, stop this pidgin thing abeg.
    return to base, i beg.

    ReplyDelete
  3. The latest new and mind blowing tope alabi songs click for downloading.

    ReplyDelete